Una see this ongoing feud between Wizkid and Seun Kuti?
Suen for sometime now don dey yab Wizkid and him fans for days on end, dey say him papa big pass Wizkid
After some time, Wizkid react with the worst of profanities and Seun people, including one of his yellow pepper sister, also put mouth mudding the very clean debate
Mbok, who is the bigger star and personality be the question on the ground
Leave the agbaya things wey Seun dey do comparing him papa with small boy Wizkid instead of him to dey compare himself who is also a musician with wizkid
Seun is a bonafide Afrobeat star and as such, he shd be comparing himself with Wizkid who is also playing at the same dispensation instead of anmoyingly throwing up royalty from his fathers works as a basis of his superiority
Well that na him own matter, make i put mouth for this matter.
Me dey always look at the data, the figures in these kind things. May be na my background as an Investment Banker sha
For me, Fela has always been overated even in his prime.
Remember when he came out of jail come go do concert for National Stadium and na less than one quarter come out for the gig?
Till he die, he no make mainstream internationally, him power begin and end for France
Even them Manu Dibango, Hugh Masekela and Mariam Makeba dem big pass am internationally.
His earnings were lukewarm and apart from some big gigs on Europe, he no really play any serious arenas for America where it matters the most
Everyone knw say if you know hit America, you never start no matter wetin you be anywhere in the world
Go ask Beetles, Elton John and all those big British acts down to Spice Girls and even that Simon wey dey frown everywhere for Pop Idol abi wetin dem dey call those things
Up until Fela die one can safely say na local champion wey we all love to bits more for his acyivism than for his artsitery.
I know know him earnings but I knw say even at that time. Dem KSA and Obey dey earn pass am locally and Internationally even them KWAM 1 come dey try am
Wizkid is a mega star in every indices of measurement.
He dey fill stadia on every continent in the world, he dey earn trillions in streaming income, don win grammy, get facial recognition globally and they trash billboard records like play
I know say una go come dey say na different era, mbok statisticians know how to do those figures and accouht for inflation and all that, if you do that you go see say Fela no be Wizkid mate as Wizkid pass am by far.
See wetin blow Fela carry am commot for the periphery of international circuit come small mainstream na the broadway show wey dem Jay Z do
Na him lifestyle drive that project, him activism, him black counscousnes wey come tie to the daily struggle of blackman for america na him make those people do that musical
That musical come re introduce the Fela struggling image to the world and he come achieve CULTURAL ICON image like them Marcus Garvey, Che Guevera, Malcolm X
Na him come make dem dey sample him music for movies and all of that
Without that Broadway show, we for just dey read Fela for Newspaper and book.
When Fela dey, he try Bob Marley? He even try Ziggy Marley?
Did Fela play Madison Square Garden? Wetin he even do at the top when he dey alive
Pls my vote is for Wizkid. The boy has broken all rules, firmly sitting on the hallowed halls of global music with huge respect and earning the kind of Money that would have just made Fela forget about him pant and start wearing suit.
The other day at Morayo show, she asked me if I would do a play on Fela and i said NO
he don too much, Fela, Fela, Fela, Fela mbok he don too much, make we look other people wey do their own too. na why we do KSA and Obey who if you ask me even achieved much more than hom internationally (KSA first am get Grammy Nominations. I mo sure say Fela get, correct me if im wrong)
Make we no look only lifestyle and cultural significance for this matter. Make we look the figures, stats, even the cultural thingy sef and put the era all join Fela holds no candle beside Wizkid
My sister Bolanle dey do well with her Fela Queens make she continue, wait make person try Wizkid the Musical na that time una go come see wetim money and artistry dey talk.
Fela form afrobeat and these boys don take am go stratosphere even Fela for him grave go dey thank them cos anytime, dem blow spotify records, the world go remember Fela
So make Fela chikdren wey na only Bang, bang, bang wey be the only hit all of them – Seun o, Femi o and Made don do go siddon
Make dem dey thank Wizkid and the rest for keeping the flag fkying cos dt thing wey dem dey sing na only Hemp loving people dey listen to am for Alausa.
Mbok when una vex reach una go come beat me
I stand wth Wizkid on this one
Thank you
Duke of Shomolu
Last modified: January 21, 2026
