Who say you die. People like u no dey die. Abeg wake up make we go find food chop, which kind joke be dis na
No be u, I see for Pastor Itua church the other day, wey I dey yab you say na food bring you come and u come dey beg me for Afang
I come say make we raid the church food first and we pack the packages and start to chop dem puff puff just this last week o
Which one dem come dey tell me say you sleep, u no wake up
You wey plan to win Nobel Prize go come sleep you no wake abi na the ashawo you carry wey drain you like this?
I no want dey hear this kind talk na. Everybody dey call me, person even send me our pic wey we take with Tade say you no gree wake up
I call your number, he ring meaning say you still dey sleep or you dey toilet dey shit
Then Obinna call me say him dey among people wey go identify your body for mortuary
Mbok how that your big belle go dey for mortuary. You don go lay down there with them Alex Okubo wey carry six pack go there.
You wey I knw, no go send. You don carry big belle go lay there now dey embarrass person. Hope say you shave your pubes cos from that bear bear you carry, he no be like say you shave your pubes o
Which kind wahala be this one again na. Topiro Mascaw don go and dem don form group quick quick put me inside
I no gree look the pictures o, even the one wey you were monkey jacket dey talk dt your usual crap wey you dey call spoken word, I no open am
See Tope wey no sabi fuck, see Tope wey no sabi fight, see my aburo wey suppose come do spoken word for my burial na me come dey do spoken word for him dead bed
I no want cry as I dey write cos Tope na idiot. Person wey no sabi timing. How he go die before June 12
Na so him own thing dey be. He go waka put chest out, bend hand like say na him get Eko Atlantic go come dey do like say him be guy man
Na why women no like am. They say he jus wake up one day waka commot for marriage leave him pikin
I say why na, he say no mind them, buy me drink
Tope na wanderer. The real wanderer, no be fake like me wey wonder but still get vestiges of normalcy wey hold me down
Tope na rolling stone, na where night reach am. Na there he go sleep
Na so he come my hotel for Lekki wey me and my man Lami dey run
We throw girls inside pool, drinks and food and Tope say make I sleep one night i say ok, Tope sleep months
Every day I go go him room, we go gist, I go forget ask am money. We go gist, laff play and chop
One day, I go meet am. Tope, I want run away o. He say why and where, I say we dey owe Landlord of Hotel N17m, so I dey run o
Tope say wait make I pack, I say wetin you bring come, you wey no get anything. He say he get load, I say oya pack make we see
Tope pack phone and charger and one bottle of whiskey say Oya he don ready
I laff nearly die. Topiro na your load be this? He say edgar my guy, make we run na so we run commot for hotel
Since that day, anytime tope see me, he go ask how far dem don catch u, me go say wey your load, we go laff
Tope come watch show, call me asides say he want act. I say Tope be like say you don see actress you want nack, he say seriously, I want act
I say go try yourself. Laff want kill me, person wey never act for him life want try stage instead make he go try blue film with him big belle
Surprisingly, he get the role and he was in GOWON
Na the second to the last time, I see am alive be dt before we go thief puff puff for Pastor Itua church
Hmmm Tope don go? B like say I still dey sleep, make person come slap me wake up o
Kai
Duke of Shomolu
Last modified: June 12, 2026
