Edgar, let’s see how this Iran war is going to pan out
My person get cancer of the kidney
Duke, make we pass for this one
Na good Friday, we no dey go out
Make the petrol price come down first
Who be Kokoro
I’m building a bridge for my village I’m short of cash
Last December, you no give me anything to drink for that your play
We just change MD, make he settle down
The person wey go approve dey leave, she go resume for May
When u ready do Play on person from my tribe, come
I support your Asaba Play and you yab us after
You promise to move all the money to our bank, and you no do. You even move the one we give u to another Bank
Edgar, you write article yab my oga he no want hear your name
The Plays too much, abeg make u rest
U no dey structured, when you dey structured come back
Why you no build ur own theatre like Tera Kulture, na dt time I go knw say u serious dn i go give you money
Edgar mbok leave me, I no get your kind money
Shebi Otedola and Dangote na your friend, wetin you dey find with me again
The acting for ur last three plays poor na why i no want support u
Typo full your letter, i no fit even read am
Make una help me. Laugh o😀😀😀
Duke of Shomolu
Last modified: March 24, 2026
