A Fada pays a deposit, 10% of agreed sum and the protege goes ahead and spends over 6 weeks to write 62,000 words, shuttling between Yaba and Ajah weekly and at the end of the day, Fada says – i just bury person, I no get money pay.
Protege say he no do again, commot my name for the book, Fada agree and goes silent
Some months after, ‘mumu PA call to ask if na true say, I No want my name for book and I say yes I no want as Fada no gree pay.
I shout and mumu PA, just reach me now say – you dey smear us, you no tell people say we pay advance
I don tell una say Fada pay advance o
Mumu PA say cos I dey carry out smear campaign because I no mention say dem. Pay me advance
Mbok my people, dem pay me advance o, na why he threaten to beat me up, verbally abuse me and refuse to pay balance.
Me na orphan, my papa no be Supreme Court Judge, i no dey smoke Igbo, i no get anybody to fight for me, I just dey naked o
All I am saying be say, make dem no ever call me again, I no want the balance , I ready to refund the deposit, this was just one of those mistakes we make in life.
When the book come out, we go read am and if any of my writing or anything wey link me to the book show, we go issue disclaimer.
I be illiterate and orphan, make una leave me oooo
Help me beg am. Make he leave me o
Duke of Shomolu
