Sim Fubara be like prick wey no gree stand
Most men wey don 50 and above go don experience this thing
When u stand see woman open leg and ur thing no gree stand.
U start to panic, u grab the thing, dey rub am, dey pull am and the thing still no gree wake up
Infact the more u pull am, d more the thing they shrink. U go begin to vex with urself, u go dey tell ur self say – na me o, na me o, na me wey nack twelve women last week o, abi no be me give teacher belle dt year
The woman lay there, open leg dey wait for you. Her look dey taunt you, her eyes dey ask if you no be man
If na person you don nack before, she sef go dey wonder wetin happen. She go dey ask you if u take anything and the more she dey ask the more you dey sweat
So the mind dey, the courage dey but capacity fail u. U don see woman and u no fit nack
Na wetin dey do Fubara be dt. He get mind, he get courage, he don vex reach but him thing no gree stand
So like the young girl, Rivers state don stand up from bed, wear cloth and commot for room
If you see the conditions wey dem set give am bfore he resume, you go either laugh or you go pity am
If the conditions na true, then dem don unleash P Diddy on am and its so sad that this time, P didy no use baby oil.
Dem say he no go go second term, he no go get hand for LG elections, he go pay legislators wey want impeach am all them money and various other conditions
This condition be like condition wey that girl go give the man for a second attempt
After the man something no stand up, the girl don go somehwere else go collect better nacking so nacking no be her problem again so na CSR she come dey with you.
And to risk wasting her time again , you go pay with your nose.
Buy hair, pay house rent, buy her papa walking stick. If na per hour for Shomolu before, now una go upgrade to Ab&B for Lekki.
If the thing no stand in 5minutes, she go leave, so anything you want do make he stand, do am
Na the kind conditions Sim masters give am and as him self confidence don erode, he no go cross him mind to take a stand and resign o
As the mumu wey him be na, he gree to all and dey expect say dem go give am free hand.
People wey he don show before, this time dem go dey very impatient with am as any little thing he do, dem go wring him neck
Just like the girl wey like to nack but cos of the lucre she don come open leg again and just as the man try him best achieve semi turgid erection as he enter, him confidence fail am after two minutes, the girl go just push am stand up wear clothe go find real man
Na wetin go happen for this his second coming.
Once he enter, the very first mistake, dem go drive am except him agree to be mumu through out
That is as he no fit nack, he go either help the woman cum with other appendage s or them go send am message make real man come finish the work
Either way SIM come be like that thing dem dey call ‘okobo’.
Na here I siddon make he come beat me
Duke of Shomolu
