Written by 6:38 am My People

Dr Austin Ebose – no just try yourself oo

I don write and cancel this essay so many times, that I don tire

When it comes to writing, I dey flow but this Oga Austin own, I no just know wetin dey happen

Oga Austin is doing birthday today and the silence is defeaning

Him person, Nelson call me that I should send quote for him birthday, I ask, is there party?

He say he no sure. You know say this Nelson no too like me, so I no trust this him response

So I wait tire, I never hear anything

May be true true Dr wey brilliant too much no one do anything this year cos last year he scatter ground o

Come and see wetin he drop for Civic Centre last year, be like something for Las Vegas

You know say him na showman, come and see wetin he wear and wetin him madam wear – that one na everyday she dey fine

Even Patorankin drop the roof and the party was now labelled the best ever by Hollywood press

May be na say I wear skirt go that day na him wan make them no invite me this year o

Cos as I wear the skirt, people forget Austin Monkey coat come dey take picture of my skirt wey Mudi sew for me

Austin come vex, come say make dem no give me food. But me, wey be correct Shomolu man, I wangle my way collect puff puff

May be na why dem no want involve me this year, come dey do secret party

Me, wey I don bribe Tayo and Tayo go release information quick quick

Every where just silence, all him inner circle no gree talk – Rufai just quiet, that Warri Comedian no talk na only that mumu Fada remain and me no fit ask am as he don shit for church

Anyways, me don ready for Austin today. I go land that him wonderful house for Ikoyi by 6 am, use my Mini block the gate, cut off electricity to the house and move in.

Nobody go do party for my back – na wetin- nobody go do that kind party for my back

Austin birthdays suppose be national event cos na for there I dey see better snail chop even though dem no dey serve afang but the sweetness of the snail is ok

Dr Ebose na my only friend wey brilliant. The man too get sense and he wise

Na him dey win all argument for our circle. When he talk even Rufai dey silence

But Austin na good man. Him kindness plenty and na fine man wey sabi dress

I go delay my hailings and prayers until I locate the party and make sure say dem never side line me

Till then, make I just say – how you dey bro

He go want beat me now o

Duke of Shomolu

Visited 1 times, 1 visit(s) today

Last modified: August 10, 2026

Close